Saturday, September 6, 2014

Tell Iyayi Idemudia Will Win*



TELL IYAYI IDEMUDIA WILL WIN!

Who just dey go again
Among us, wey dem dey yanmutu
from time to time.
Abeg who dem beasts just penme
whether for waka abi sleep
whether as padi abi 'i no go gree'
who dem just...abeg, who?

And if una plenty,
wey dem just put for underground
make una tell Festus
say we don tire for cry
and to dey pray for 'rest in peace'
Tell am say we no forget im word
say na dem Idemudia go bail themselves
from these kleptos and vampires;
say na make workers no look back
to comot dem bamboos
wey no dey work at all;
but dey chop dem all.
Say this system no fit better,
abi make im get Jesus.
Na we must pafuka am
and put we own kajola-
where sorrow go be fable
and liberty go be dailybread.

make dem tell Prof
say even if im don go
im work dem dey our heart
and we go dey follow am
and dey tell dem mekunu
say no messiah dey from heaven.
na we go fit change am for them barawos
wey no go allow us gbadun
from our sweats and commonwaelth.
dem own pikin dey go better school
but Idemudia no get kudi
to send pikin go even the rotten schools.
our health na haram for them
and wetin we go chop no mind dem.

Abeg tell Iyayi
Say im don do well
and we no go forget am.
na make dem Idemudia no dey fear at all
make dem hold 'arms in arms'
To send dem Obofun comot
with dem powerful waka like ants
for the streets and workplaces
make nothing divide us at all,
whether race,religion,or gender.

Abeg tell our comrade
say if dem dey do aluta for yonder
make im do am till uhuru
for we for downtown go continue to dey fight
as im don sure say,one day one day
Idemudia dem go win for here and the whole world!

Iyayi, I throway salute o!


A POEM WRITTEN BY KUNLE AJAYI*